Saturday 22 June 2013

Courtois go remain for Atletico Madrid

Thibaut Courtois © Action images


Chelsea Belgium golkipa Thibaut Courtois go still remain for Atletico Madrid on loan for anoda seasin, de La Liga club tok on Saturday.
De tall Belgium kipa wey don dey Spain on loan now reach the third year so go kontinu for dat side as Jose Mourinho dey prepare to start work for Chelsea.
De 21 yeard kipa wey win Spain "Zamora" cupfor kipa wey get de smalles gols for hin net for one season, bin kuku to say hin wan stay for Atletico side dey kontinu to play ball.
Hin tell Atletico website (www.clubatleticomadrid.com) say hin wan stay play Champions League with de Spain team nes seasin.
Courtois don play 98 matches for Atletico, come helep dem win Europa League for 2012, de Euopean Super Cup wen dem beat Chelsea for de final, and also las seasin Kings Cup for Spain wen dem beat Real Madrid for final.

No comments:

Post a Comment