Friday 21 June 2013

Leroy don waka


Claude Le Roy © Action Images

Plenty sand don pour for de garri of de oga coachi for DR Congo, Claude Le Roy as him don kommot as de manija of DR Congo on Thursday nite.
Na de coachi himsef yarn amebo people dat him no dey work again for Congo.
“I don tell my playas dat I no dey work again afta de two years wey I take dey with dem.
“Me and de oga dem for de federation no dey gree and de beta thing for me na to carry my bag waka and I neva even know wia I dey go now,”. Naso de coachi tok.
Le Roy wey be 65 years old now became de oga coachi for DR Congo in September 2011 and de man try as him carry dem go de 2013 Nations cup for South Africa afta 3 times wey DR Congo don fail to qualify.
But DR Congo no fit waka pass de group stage of de 2013 Nations cup and walahi dem no gree lose any match at all for all dia group games.
Minwile, DR Congo don fire Le Roy assistant, Sebastian Migne as dem tell am say make him dey follow him oga dey go.

No comments:

Post a Comment