Friday 21 June 2013

Uruguay manage wire Naija


Forlan © Gallo Images

The Supa Eagus of Naija don chop dia fess bulala for de 2013 fifa confederations cup wey dey carry on for Brazil as Uruguay flog dem 2-1 for dia second game on Thursday for Arena Fonte Nova Stadium.
Walahi na from de fess minute na hin Uruguay start to de nack Naija plenty attack as dem been wan score dem early early for de match, but na lie as all de shot wey Uruguay dey play no gree enta Naija net.
Ahmed Musa be de guyman wey kon waya de fess attack for Naija in de 7th minute and naso one Uruguay defenda go nack am for ground bifor Mikel Obi kon troway de freekick wey de refiree carry givr de Supa Eagus.
Naso de match dey hot dey go bifor Uruguay kon score dia fess gol in de 19th minute wen sabi strika, Diego Forlan play beta corner and naso Naija defendas juss dey look like agbero as dem allow Diego Lugano to nack Enyeama de gol.
Chelsea midfida, John Obi Mikel kon make Naija people and dia fans happy for de 37th minute as him ekwalise for de Eagus and na like dat de fess haf take finish.
The Naija Supa Eagus tap beta ball wen de second haf start, but gol no gree come for dem and naso Uruguay winga, Diego Forlan kumma carry counter attack go score dia second gol in de 51st minute.
Supa Eagus try afta Uruguay nack dem de second gol as dem no wan lose de game, but all de gragra wey dem do no gree bring gol and naso de game take finish.
The koko now be say de Naija Supa Eagus fit still kwalify for de semifinal of de confederations cup if dem bulala Spain for dia lass group game on Sunday.
But dat one go hard dem small as Spain no gree pity Tahiti at all for dia second game as dem skatta dem 10-0 to collect de fess semifinal ticket for group B.
The thing don sure now dat Uruguay go skatta Tahiti for dia lass group game as na promo dem be, abeg Naija go fit beat Spain?

No comments:

Post a Comment