Thursday 20 June 2013

Gattuso na new Palermo coachito


Gennaro Gattuso © Gallo Images



Foma Italy and AC Milan midfida, Gennaro Gattuso don become de new manija for Palermo and de club don tell am say make him helep dem promote back to de Serie A.
Na one year contract na hin Gattuso gree sign for paper for de club. The guyman don win two champions League bifor as him also dey de Italy team wey win de 2006 world cup.
“Palermo and Gennaro Gattuso don chop knuckle as na him be de new manija for de club,”. Naso Palermo take put am for dia website (www.palermocalcio.it).
Gattuso wey don clock 35 years old now go replace Giuseppe Sannino wey don waka from de club as him no fit save Palermo from relegation lass season.
Na Gattuso be de foma coachi and even playa for FC Sion lass season, but him no jolly at all for de club bifor dem kon fire am kommot.

No comments:

Post a Comment